Kangpe lyrics

Kangpe lyrics

So na so it be na condition come make you aje like this
You say your husband na him leave you, you say I go fit betray you.
So na so you dey weak
As I see you before I think say you dey kangpe=(strong)
Nothing fit, fit shake you, nothing fit, go fit break you
Na you rake before
Na you talk say you no go put man before God
See yourself as you be
Na you talk say you no go put man before God oh

Chorus
As you know, God no go give you anything you no go fit deal with
Na so dem talk, the thing wey no fit kill you
It go make you strong, it go make you strong
The thing wey no fit kill you, it go make you strong
The thing wey no fit kill you, it go make you strong
God no go give you anything you no give fit deal with

Verse 2

You talk say, you de big man
Cause if you raise your hand fit beat your pickin=(children), beating your wife
You sabi=(know) Bible well oh
Dey go church everyday oh
Notice me or I quench
Look at me how I bounce
But na you be the crook
Na your kind fit open eye, kill person, misuse and abuse him
419, ole thief, basket mouth, ojoro
But you know how he be
When wind blow, fowl yansh=(bird's ass) go open very very well oh

[Back to Chorus]

Yeah man
one question!
When was the last time you ever thanked the Lord Almighty for your life?
When was the last time you tell your wife, say you love her?
When was the last time you tell your son or daughter, say you love them?

Bridge

And as I walk through the valley of the shadow of death
You will fear no evil
For his rod and his staff are with you
You’ve come this far to sing your mystery